
Djinee’s Ego was one sound that rocked the screens of Television sets in so many Nigerian homes for a long time; On this episode of #TuneBackThursday, we would like to take you back in time to this love song, with the lyrics this time to spice up the fun.
Watch below and sing along…
Lyrics…
If I die now, I go happy say,
Say when I dey this world, I don fall in love,
Which one u dey e
Wey u dey treat me so,
I don beg, I don do everything
But u tell me say u need time and
U no fit dey wit me
Na so I vow,
Anyway, I dey go, Ewo!
CHORUS
If u help me see Ego,
make u tell am I don go,
She no look me and so,
don pack my load go Ewo!
(2xe)
No, be say I no show how I feel,
No, be say I no ever show you say I dey real,
Everybody don know say I fit do anything for you,
I go die for you,
Everybody dey laff me cos dem know u be my life,
I don say I go marry,
cos in u I see my wife,
Baby oh!
I go take am 4 bus,
I go take am 4 train,
For this place, I no fit stay eh!Ewo!
Chorus(2xe)
I know say u dey hear my voice,
cos this song na im I write for you,
I dey go find one place where I go hide my head,
cos I wan start my whole life anew,
Chorus
She don leave me and so so,
Eh Eh Eh Ewo!
Ego Ego Ewo! (see ego tell am I don go)
Why u do me so
Why u do me like this oh!
I dey beg, I dey beg, I dey pack my load go
Oh Oh!
If I die now I go happy say,
Say when I dey this world I don fall in love